Big Brother Naija 2020 housemates: Terry Waya billionaire son Terseer Kiddwaya na contestant for BBNaija season 5 'Lockdown'

Kiddwaya

Wia dis foto come from, Bigbrother Naija/Africa Magic

Terry Waya billionaire son na contestant for Big Brother Naijaa 2020 Lockdown season.

Terseer Kiddwaya na 27 year-old self-employed man wey come from Benue State.

E describe himsef as confident, good looking, ambitious and pesin wey dey highly motivated.

E say im also dey confident and arrogant all at di same time and love travelling.

Di grand prize for di Big Brother Naijaa 2020 Lockdown season na 85 million naira.

Arrogant and confident, na wetin Kiddwaya say im dey cari waka enta Big Brother House.

Skip Twitter post
Allow Twitter content?

Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Twitter post

Being a Big Brother Naija season 5 Housemate don make Kiddwaya dey expect a better and crazier 2020.

E describe himself as confident, good looking, ambitious, a daredevil wey dey highly motivated.

"You never know wen your time don finish, so you fit as well go for am" Dat na Kiddwaya favourite words.

"Getting into health and fitness na im Kiddwaya say be im biggest achievement. I bin dey quite chubby, so I transform my bodi and I don dey consistent ever since."

Kiddwaya papa Terry Waya, wey be famous socialite na London-based Nigerian businessman.

Oga Waya age 55 bin reportedly face some kain case for British court between 2006 and 2008.

Terry Waya na native of Tiv for middle belt Nigeria.

Di Nigerian socialite wey love Versace wella bin give interview for May 2020 to Nigeria lifestyle and celebrity tori pesin Dele Momodu.

Skip YouTube post
Allow Google YouTube content?

Dis article contain content wey Google YouTube provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Google YouTube cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of YouTube post